Wednesday 25 February 2015

Photos and highlights of how e happen today for inside Brekete Family radio/tv show 25th February 2015.




Mother of the girl with protruding eye problem, Blessing,  giving gratitude to Brekete Family for all the support.



My brothers and sisters, today episode of our family love radio and tv show, Brekete Family really chook everybody for liver kumemeh.

The main highlights of the show today be say:

1) Our sister wey her eye bulge out done go do the CSCAN test and doctor done talk say she go need to go India for proper treatment. Her mother also come studio to thank Brekete Family and Nigerians for the assistance wey God use the family de do for her and her pikin life.

2)  The super Blind Man wey him name be Yakubu Festus aka the Farmer, come studio to give small support to the girl wey her eye bulge out and internally displaced people. He give the girl 5000 naira and come donate 50 tubers of yams and 20 mudus of guinea corn to the internally displaced people. abeg make una give am 3 hembelembeh!

3) As God continue to de use Brekete Family to dey bless the under privileged people, na so we  go continue to dey thank am o. Today belle sweet everybody for studio when the prestigious Kinsey College of Education, Illorin offer scholarship opportunities to 100 students from less privileged homes. So, if u know say your WAEC, NECO, GCE, NABTEB certificate de kajad and money no dey to go school, carry yourself dey come to Brekete family ooo. Opportunity to go to school to land. Hembelembeh!!

Make una continue to de feed una eyes with more pictures from the show today. Una Hembelembeh!!! 


As the woman  dey share her touching story, The thing come chook people wey dey inside studio for liver kumemeh! We thank God for his mercies

The ordinary President was overjoyed when Kinsey college of education, Ilorin offered scholarship opportunities to 100 students from less privileged homes.   He come break into serious dance oo. God is good.






The powerful blind man wey support our sister with eye problem, Blessing, with 5000 naira. He also donated 50 tubers of yams and 20 mudus of guinea corn. Hembelembeh!


Na the representatives of Kinsey College of Education, Illorin be this.

Representatives of Kinsey College of Education, Illorin with the Ordinary President.








9 comments:

  1. May God increase you all in every ramification.. i nor know weytin to pray for una again self. Peace. Amen.

    ReplyDelete
  2. May God Almighty continue to dey grant una more grace. As una dey labour for God vineyard, so shall he take care of una own too. And to the president Odinary Ahmed Isah my prayer for you is that God will cause to experience joy and fulfillment all the days of your life, anything wey your money no go fit buy people go give you free of charge. God bless you all.

    ReplyDelete
  3. hhhmmmmm wit Ahmed Isah sumtyns ar possible bt wit God all tyns ar possible. May Almighty Allah bless dt blind man abondantly. Nd by the grace of God, blessing go regain bck ha sight. Hemhemhem belembe.

    ReplyDelete
  4. Thank God for this family and more blessing

    ReplyDelete
  5. Thank God for this family and more blessing

    ReplyDelete
  6. May the Lord increase His grace upon your life.
    Almighty God will continue to provide help to you, so that you can be a helper to the needy.
    May the Lord bless you and bless our country Nigeria.

    ReplyDelete
  7. God bless Ordinary Ahmed Isah 4 d gud works. and also blessings to his faithful crews

    ReplyDelete
  8. Oga Ahmed Isah..e get one scam wey dey happen for naija now including Abuja, some faceless organization dey use people wey dey sick dey make money that is not even accountable in the name of raising funds for them to treat their ailment....,abeg e go good make we investigate this issue, cos e dey bad to dey deceive this people because they need help.

    ReplyDelete